One lawyer dressing for court cause small drama for Abuja, Nigeria capital on Thursday, 23 June as e add traditional elements to im attire.
Ontop di expected cloth wey lawyers go wear, wey be wig and court gown, e paint one of im eye wit white paint and follow put calabash wey get cowries and red rope around im neck.
Di lawyer wey show up one Supreme Court proceeding tok say di latest judgement by di same court to uphold di use of hijab by female Muslim students for Lagos State goment-owned schools give am ginger to do im own dressing.
No comments:
Post a Comment